#Covid_19: We Need More Protection Equipment for FMC Lokoja – Dr. Agwu, Doctors’ Presido By TalkHealth9ja
#Covid_19: We Need More Protection Equipment for FMC Lokoja – Dr. Agwu, Doctors’ Presido By TalkHealth9ja As Coro dey jump like monkey from one pesin to another inside we country, plenty bodi-mata people don dey yan government to make sure say enough protection equipment dey. We follow the Oga Presido of the association of doctors wey dey do higher training to become specialists (a.k.a Association of Resident Doctors – ARD) for Federal Medical Centre (FMC) Lokoja, Dr. Nnanna Agwu talk dis weekend and im tell us plenty things. We go dey komot am small small. Dr. Agwu talk say im hospital no get protection equipment wey oyinbo call Personal Protective Equipment (PPE) wey doctors, nurses, and other bodi-mata workers go use dey protect themselves from Lassa Fever and Coro as dem dey work. These equipment include hand special hand gloves, face mask, eye googles, face shield, head cover, gowns, etc. He yan say e reach 9 people wey don kpai from Lassa fever dis year alo